Police commands for some south-west states for Nigeria don sama serious warnings give any hoodlum or cult groups wey get plan to celebrate dis year '7/7 Neo Black Movement of Africa aka Black Axe Day'.
Di warning from di Lagos, Oyo and Osun police commissioners dey come as 7/7 begin trend for Nigeria social media.
Police say 7/7 na day wey cultists dey do procession and unlawful gathering wey fit lead to breakdown of law.
For inside statement, di commissioners say dem ready to deal wit organizers or anybody dem catch wey dey plan to cause violence for di states
Like
0
Sima Bhim
Delete Comment
Are you sure that you want to delete this comment ?